BIG MAN NO BE BY MOUTH

eruems
4 min readJun 6, 2024

--

Na from small them alter my thinking. Since the time when I start to dey recite 2x table naim dem give me orientation say me na big name. One sunny afternoon when heat dey beat my neck like person wey tiff bread for sabon gari market, my papa look me tell me say nothing concern my future with sapa. He yarn me say my place for this world na where big men dey siddon.

Na with this kain mentality I take start life. I always dey admire big men dey reason say one day I go just open my eyes for mansion with better SUV and one bad woman as my own. When them give me this orientation I been no know say big man no be by mouth.

As I show secondary school, I begin dey see sign small small say I suppose be big man. Throughout Jss1 I dey among top three for class. The only guy man among the top 3 — the other two na bannies. I start to dey form blessed among women. I dey waka round school with pride as per I don dey see wenti my p.man been yarn me that afternoon. As e see my result e laugh give me soft drink make I use chill. My mama dey smile like say I be dangote. I spread leg dey chop hailing like gutton. I forget say big man no be by mouth.

Second year for school Ebuka show for my class. E first ask who be the top students for class when I hear am I think say e just dey find talk, I been no know say e come school with better plan. End of term baba elbow me lost. I shock as I see my result. I swear give my people for house say I go bounce back but the same way Arsenal chop beating for Man u hand for 2011/2012 season naso I chop beating till I manage graduate from secondary school. I been no get OT say big man no be by mouth.

013, I pass jamb enter university. Before I go, my papa clear me say no food for lazy man. If you no work hard no reason food. Na from this yarns I understand say to siddon for where men wey get levels dey siddon I suppose work hard and no just to dey work hard but I suppose carry sense join am because if na only by hard work the bros wey dey push truck for area for be billionaire by now. Na with this mentality I take fight for university but as life be, small small distraction been dey drag my shirt. I manage carry 2:1 run commot.

Na with this reasoning I enter corporate Nigeria. I observe the space until e clear for my eyes say my dreams fit collapse like our national grid. As soon as my eye tear, I japa commot. The goal na to find one area where I go fit camp until I drag my dreams enter real life. I still dey road — I never reach where big men dey siddon, my bad woman na still imagination and I never sign paper wey go give me SUV but I swear I dey road and like that boy for Jss1, I don dey looseguard again.

I dey write this story because the way I dey lie down for bed e dey like say I don dey forget say big man no be by mouth. Even though I don get small achievements for my side, I never spread leg on top my own verandah dey admire my suv for garage with one bad woman to press my back. I dey write this story because e dey like say I don forget say I promise my people for area say I go do my best and nothing for this life go end until I win. E dey like say I don forget say dem don write my name for high table and to climb that table I gats turn Mike Tyson. I dey write because e dey like say laziness dey look me like him babe but e no know say lion no dey born goat. My papa no lazy them no born me well to dey lazy. My papa smart die, why I no go work smart? I dey write this tori to remind myself say I suppose commot the teeth of any form of Ebuka wey go try block my way. I suppose drag my matter until I win.

See as life dey strong face for everybody, how I wan take forget say big man no be by mouth?

THANK YOU FOR READING AND PLEASE LEAVE A CLAP OR FIFTY

--

--